by Dr Waka
My people my people, nothing wey person nor go use eye see for this Italo. In short the more you look the less you see. Poor Naija, what hasn’t that nation suffer from its citizens. Naija is the only country in the world where its citizens rather than wishing the nation well will be busy cursing it. Dem don kuku turn the obodo to wrapper which everyone is now tying as he or she likes.

Recently at an event organised by Nigerian officials here in Rome, na so everybody come sit down for the commencement of the event. Nor do nor do, MC pick mic o, begin dey parambulate until hin come tell everybody to get up for Naija national anthem. Na so everybody obey and the national anthem begin play.

Before you could say “Arise O compatriot…” na so this bobo way his name resemble don king begin move about without respect for the anthem. This don king nor be journalist or photographer o, I hear for inside Termini say this bobo na operaio wey like Ethiopian and Somalian baby dem. Ewooo, dis one na international hustler.

As anthem dey play dis bobo nor gree o, na so hin dey move about dey distract everybody sotaay one oga wey nor fit watch this don king dey disrespect Naija anthem called him out to stop moving about. When the oga persisted in trying to bring him to order he turned to him and confirmed that he was a bonafide member of the Indigenous People of Biafra, Ipob wey nor care about Naija anthem. Chai, una still appear for Naija event? This one don pass be careful o.

As hin make that pronouncement na so people wey dey around open their mouths begin look this don king. To rub pepper inside the matter na so this Ipob loyalist ignore all the people wey dey look am waka comot even though national anthem still day play. The thing be say how did a member of a separatist group that Naija government labelled terrorist organisation get invited to an event organised by the functionaries of the same government? Question! If you ask me na who I go ask? Fear dey catch me o.